Wia dis foto come from, Getty Images
Westham star Mohammed Kudus go captain di Black Stars of Ghana vs Sudan for dia crucial 2025 Afcon qualifier later on Thursday.
Di Black Stars dey under ogbonge pressure afta dey secure only one point from 2 games vs Angola and Niger inside group F.
Ghana bin dey third, afta Angola and Sudan dey first and second; wia Niger bin dey bottom of di table.
For dis game, plenty tins dey at stake.
One of dem na sake of di Black Stars dey face Sudan at a time wey di coach of di falcons na former Black Stars player and coach wia im name be James Kwasi Appiah.
Appiah bin coach di Black Stars in 2012, wey im qualify dem to di 2014 World Cup.
In 2014, di Ghana football association give am 2 -year contract bifor im leave di team later in September dat year by mutual consent.
Appiah afta im lerf di Black Stars bin coach Sudanese club Al Khartoum in December 2014.
But for April 2017, di GFA don appoint am again to coach di Black Stars afta dey sack Avram Grant.
Na so im supervise di black stars to qualify for dia next Afcon in 2019.
But for dat tournament in Egypt, Ghana comot di round of 16 stage; wey di GFA tok say dey no go extend im contract.
Wia dis foto come from, SUDAN FOOTBALL ASSOCIATION/FACEBOOK
In September 2023, di Sudan football federation don appoint Kwasi Appiah as di head coach of di team.
So James Kwasi Appiah na pesin wey sabi di Ghana national team well well.
Ghana coach Otto Addon tok in September say im no fit wish Kwasi Appiah di best for dis game.
“We all sabi Kwasi Appiah, na great pesin and good coach, I dey like am,” Otto Addo tok for one CAF seminar.”
Im add say “normally I go wish am well but for dis time, I neva fit do dat sake of im dey play against us.”
Wia dis foto come from, GFA/FACEBOOK
Team news Ghana v Sudan
Ahead of di game, CAF don write to di Sudan coach wey dey give am up to 8 October to step down from one of di two roles im get – as Sudan coach and as executive committee member for di Ghana football association.
Inside one letter to di 64-year-old, CAF tok say na conflict of interest na so dey ask say make he drop one of di two positions or im go face di disciplinary committee.
Na so coach Kwasi Appiah now step down from im role as executive committee member of di Ghana football association.
For di players, di big blow na Arsenal star Thomas Partey wey pull out of di squad sake of injury.
LA Galaxy forward Joseph Painstil also bin withdraw sake of injury but Jordan Ayew and Fataw Issahaku from Leicester both dey available togeda wit Monaco defender Mohammed Salisu.
Mohammed Kudus go be captain for di team for Thomas Partey im absence.
Athletic Bilbao striker Inaki Williams and Bournemouth forward Antoine Semenyo also dey available for selection.
Fernabache defender Alexander Djiku wey miss di last games due to injury also dey available for di Sudan game.
Wia dis foto come from, SUDAN FOOTBALL ASSOCIATION/FACEBOOK
For di falcons, Mustafa Karshoum don train well for di team dia last training for di Accra sports stadium, wia im dey fit.
Sudan Striker John Mano wey tok for pre-match conference explain say di falcons dey ready to cause upset vs di Ghana Black Stars.
“We dey enta dis game to beat Ghana, na victory we dey pursue afta we lose our last qualifier vs Angola. For dat game, we don deserve to get one point, but na football.”
Anoda Falcon striker Mohammed Issa also na key player for Sudan wey im join di team on Tuesday for Accra.
For Group F, Angola dey top wit 6 points; Sudan get 3 points, Ghana and Niger dey third and fourth on di table wit only one point from two games.
Ghana vs Sudan head-to-head
For di last 5 games between Ghana and Sudan, di blackstars don win 4 wia di falcons win 1.
But overall, di two teams don face each oda 9 times since 2009.
For dis 9 games, Ghana win 7, Sudan win 1, wia one game end for draw.
First game for Accra sports stadium in 3 years

Probable lineups for Ghana vs Sudan
Wia dis foto come from, GFA
Ghana: Lawrence Ati-Zigi, Tariq Lamptey, Abdul Mumin, Alexander Djiku, Mohammed Salisu, Alidu Seidu, Elisha Owusu, Majeed Ashimeru, Kudus Mohammed, Antoine Semenyo, Inaki Williams
Sudan: Mohamed Mustafa, Ramadan Agab, Bakhit Khamis, Mustafa Karshoum, Abdelrahman Gaafar, Salaheldin Adil, Abdelrazig Omer, Walieldin Khidir, Abo Eisa, Saif Thierry, Mohamed Abdelrahman